Barbara Banda class lead Zambia to victory over Senegal

barbara Banda celebrates her goal

Wia dis foto come from, FOOTBALL FEDERATION OF ZAMBIA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Ndiaye score for Senegal first bifor CAF player of di year Barbara Banda don equalize

Two goals from di 2024 CAF and BBC Women's player of di year Barbara Banda lead Zambia to beat Senegal 3-2 for dia second group A match.

Di Copper Queens bin start di game well wia dem bin put pressure on top di Terenga lionness.

But na Nguernar Ndiaye wia score first (5th minute) for Senegal bifor Barbara Banda equalize for di twelfth minute.

From dat point, na all Zambia wia dem finally score dia second goal through Rachael Kundananji, afta dem disallow two of dia goals for offside.

Her goal for di 51st minute now release di pressure for dia top bifor Barbara Banda don score her second goal for di 74th minute.

Dem bin get penalty shout but afta di VAR check referee cancel her initial penalty decision.

But afta di Zambia third goal, Senegal now begin to dey press wia dem bin get penalty for di 80th minute.

Goalkeeper Musole don hack down striker Nguernar Ndiaye as she bin dey ent di box to score.

Ndiaye carry di ball wey she score di penalty; her second goal for di match at 3-2.

Di final 10 minutes plus di added time (10 mins) na all Senegal as dem bin pepper di Zambia defense to score di equalizer, but di Copper Queens hold on to win dia first game for di 2025 Wafcon.

Di win take Zambia to four points on top di Group, wia Senegal still maintain dia three points fro dia first game to keep di second position.

All di teams gatz to ensure say dem no drop points for dia last round of games to have a chance to progress to di knockout stage.

Di oda teams for dis group na host nation Morocco and DR Congo wey go face each oda afta dis game.

Second Half

FULLTIME!

Referee don blow whistle to end di game. Zambia bin win di 3 points afta di late fightback from Senegal.

Zambia dey make one final change to waste some time afta dem hurt Tembo.

90+10" Senegal gat one more chance but di striker im shot dey blocked.

One Zambia player bin dey for ground afta Diop don push her for back.

90+8" Even tho Zambia bin dey defend, when dem get di chance, dem, dey try to hit di Senegalese for di counter.

Senegal gatz few seconds to try and get equalizer for dis game.

90+7" Barbara Banda don carry di ball go di corner flag to waste more time.

Senegal go play v Morocco on Saturday for dia last group game. If tins stay like dis, Zambia go lead di group wit 4 points wey Senegal go dey second wit 3 points.

96" Senegal dey try to still create one more chance, but offside!

Dem take di freekick fast fast wey dem try to attack now.

94" Zambia now bin dey try to waste some time, Prisca carry di ball go di corner flag wey she bin dey hold am to waste some time, las las ref blow whistle for foul for Senegal.

Chance! From di corner, Diop don head di cross on target but di Zambia keeper once again don save di ball.

90+3" Lushomo Meweemba di number 3 player for Zambia try to carry di ball from her area afta some Senegal pressure.

90+2" Senegal gatz anoda throw in for di Zambia area. Di Terenga lionnesses bin dey put plenty pressure for di game now.

Di corner dey weak, na so Zambia don clear dia lines.

90+2" Corner for Senegal. Sane go take di corner into di area.

90+1" Chaaance! Nguernar Ndiaye again collect di ball inside di Zambia box, she hold di ball bifor she lay am off to her captainKorka Fall, but her shot go over di bar!

Dem bin add 10 minutes bifor di game go end.

90+10 mins

89" Now Zambia fit clear di ball and try to create dia own chance now. But Senegal don dey defend.

87" Chance for Senegal. Dem dey try score thru Malado. She collect di ball inside di Zambia box, she dribble on eplayer but her shot dey blocked.

Senegal coach Cisse bin dey vim im players to push and push, na so Nora Hauptle dey encourage her girls to focus.

86" Game don restart. Senegal just dey pepper di Zambia defense.

One player bin dey for ground as ref call di medical team to enta di park. Ireen Lungu na di player wey dey for ground afta her own player use boot hit her head as she dey clear one ball from di Senegal attack.

84" Corner for Senegal but dem no fit carry do anytin.

Chaance! Senegal bin get anoda chance to shoot but keeper Musole don catch dat weak shot.

For di space of one minute Nguernar Ndiaye bin get behind di Zambia defence but dis time dem block her.

82" Nguernar Ndiaye wey score brace still dey pepper di Zambia defense, she bin carry di ball run enta di box but her cross dey weak wia Musole don save am

80" Di last 10 mins go sweet, as Senegal dey try to get equalizer. Zambia for dia first game against Morocco also throway dia 2-1 lead for di last minute wia di host kontri equalize.

79" GOOOOOALLL! Nguernar Ndiaye bin score di penalty for Senegal. 3-2 now

77" PENALTY to Senegal afta di Zambia keeper foul striker Nguernar. Di Zambia keeper bin collect yellow card.

CHAAANCE! Mukoma don miss wetin fit be miss of di season. Prisca Chalufya don do all di work wey she cross di ball inside di Senegal box, but di substitute Mukoma gatz to only tap di ball inside di net, but she bin hit di ball ova di bar

Di more Senegal dey try to score di more dem dey leave spaces for dia back.

75" Zambia try to create anoda chance thru Racheal Kundananji but her long shot go wide.

Senegal gat mountain to climb wit dis score.

Rachael Kundananji bin strike di ball on goal but di Senegal keeper save am into di path of Banda, she now tap di ball inside di net

GOOOOAL! Zambia don score dia third goal. Di pressure for di last minutes don pay. 3-1. Who else? Barbara Banda.

Zambia bin take di short corner, di follow up cross dey simple for di keeper to catch.

70" From di freekick, Zambia now bin win corner.

Yellow card for Aissatou Fall afta she foul one Zambia player for dia left hand side. Di copper queens go play dis one inside di penalty box

Chaaaance! Diop don head one cross on goal but di Zambia keeper Musole don save di ball.

67" Moukoma wia don enta di park now now almost get chance to score afta she collect di pass from Barbara Banda, but di Senegal defenders clear di ball.

Zambia bin comot dia number 10 player Grace Chanda.

66" Nhernar Ndiaye di striker for Senegal dey try to beat her marker but di ball go out for throw ball.

From di corner, Senegal keeper Adji don catch di ball wey she sleep for ground

65" Corner for Zambia! Prisca Chilufya try to shoot one from outside di box wey she win corner.

64" Senegal dey ask for anoda foul but di ref play on, from wia Zambia dey try to counter attack but Banda no fit to collect dat high ball

62" Fatoumatou wey don enta di game dey try to create sometine bifor di ball fall for Nguernar Ndiaye; her ball over di top no worry di Zambia keeper, she don catch dat ball simple!

60" Di Terenga lionnesses dey try to crteate chance but Nguernar Ndiaye don fall for ground afta one challenge from Tembo. Di striker dey for ground dey call for penalty but referee wave play on.

59" Senegal now dey change some players to try and bring fresh energy for dis game.

Senegal coach Cisse vex say dem no award di penalty afta di ball hit di Zambia defender from di Senegal header on goal.

During di VAR check, referee don show di Zambia coach Nora Hauptle yellow card.

Afta di VAR check, di Togolese referee don call off penalty for Senegal against Zambia.

55' VAR! Referee don dey go di monitor to check for handball against Zambia

Dat goal na reward for all di hard work from di Zambia attack. Now di two most expensive players for women football don score for dis game.

50" GOOOOAAAAAAAL! Rachel Kundananji Di most expensive player for women's football don score 2-1

49" Tins don dey settle now afta di pressure for di first few minutes bifor Senegal captain Korka Fall bin foul Rachael Kundananji

47" Nguenar Ndiaye wey score di Senegal goal dey try to hold di ball and enta di Zambia area bjut her pass wit di side of her boot dey blocked.

Zambia dey try now to create sometin thru dia captain Barbara Banda but dem foul her for di Senegal area.

46" Game don start wit Senegal trying to pressure for early goal.

Players don commot for di second half.

key players for senegal and zambia

Wia dis foto come from, SENEGAL FOOTBALL FEDERATION/COPPER QUEENS/FACEBOK

Wetin we call dis foto, Senegal go qualify for di knockout stage if dey beat Zambia on Wednesday

First Half

Halftime!

Chance! Barbara Banda get chance to shoot from one corner but goalkeeper Adji Ndiaye don collect di ball.

45+7" Di first half don dey end wit Zambia having all di chances to score anoda goal but Senegal dey defend well.

45+5" All di pressure dey di Senegal side. Grace Chanda don hit anoda shot inside di box but Seneal block am.

45+3" OFFSIDE! Zambia don score again but referee blow for offside. Barbara Banda don connect wit one cross from Rachael but she bin dey offside

45+2" Chance for Zambia as dem dey try to score but dem win corner.

Dem bin add 7 minutes to di match bifor halftime.

+7 Mins

44" Martha Tembo from Zambia bin dey rush wit di ball for di counter bifor dem foul her, referee now blow for foul instead of allowing di advantage; Zambia coach Nora Haup[tle don vex.

Defender Wolimata Ndiaye don hit di freekick but Zambia clear dia lines.

43" Freekick to Senegal.

Senegal dey try to create sometin bifor di halftime thru Diop, but dem bin foul her.

42"Anoda player from Senegal don dey ground; Ndeye Casset.

Chance for Zambia, Grace Chanda bin strike one shot fron di top of di Senegal box but di shot bin hit her teammate Barbara Banda.

40" Afta some treatment she dey on her feet to continue. Di game still na 1-1 as we don dey approach di halftime whistle.

Trouble for Senegal midfielder Bineta Seck as she dey for ground without any tackle.

38" Senegal goalkeeper Adji Ndiaye don comot to catch di ball afta one cross from Zambia. Di goalkeeper bin dey play as striker for di U20 team bifor she transition to goalkeeper.

36" Senegal don dash di ball for dia own area na so Banda get di ball and pass to her mate but di follow thru ball dey so strong she no fit collect am back.

35" For di last five minutes Senegal bin dey struggle to create anitin for di Zambia area.

If Prisca don collect yellow for dis game, she also go miss dia next game.

33" Zambia dey try to create anoda chance but refree don whistle for foul inside di Senegal box. Prisca Chilufya don foul her marker.

Zambia coach Nora Hauptle don vex wit dat decision.

Yellow card! Grace Chanda di number 10 player don collect yellow card for high boot. She go miss dia last group game sake of dat yellow card.

29" Zambia don hit Senegal for di counter again, wia dem win corner, but di corner don spol.

Aissatou Fall di number 4 player don dey get treatment for di touchline, afta dat, her coach don give am some informate bifor she enta di game again.

She don dey ground afta dat foul, wia she dey get treatment, but di game don restart.

27" Counter attack for Zambia wit Barbara Banda. Di player carry di ball enta di Senegal area but bifor im go pass di ball, dem bin tackle her wey she fall for ground.

26" Afta di game don restart, Senegal try to enta di Zambia area, but di ball don stick under di feet of Ndiaye na so di chance don vanish.

23" One senegalese player bin dey for ground afta dem foul am, she dey get treatment.

Fans for di stadium bin dey chant di name of Barbara Barbara; di CAF and BBC player of di year 2024 bin dey try to create chances for di copper queens.

21" MISS! Rachael don miss one ogbonge chance dia afta Barbara Banda don create di chance for her. Rachael don hit her shot wide

20" OFFSIDE! Prisca don head di ball into di net but di referee bin blow for offside as di number 25 player bin dey offside

19" Freekick to Senegal in front of dia area; dem bin take am quickly but di danger don scatter

16" Both teams now dey try to keep di ball wey dem dey pass am between dia players

Chance for Zambia but dem bin win corner. From di kick, Senegal bin clear

15" Since di equalizer Zambia bin dey try to put pressure on top di Senegalese.

12" GOOOAL! Senegal don equalize thru who else, di CAF player of di year Barbara Banda, wit one sweet assist from her partner Rachael Kundananji. 1-1

5" GOOOAL! Senegal Women bin score first thru Nguenar Ndiaye

3" Di early chance don fall for Zambia but Senegal clear dia lines bifor dem launch dia own attack.

2" Both teams dey try to study each oda bifor dem go try to play dia own game.

1" Referee blow whistle to begin di game

If Senegal win dis game, dem go qualify for di knockout stage sake of dem bin already win dia first game 4-0 against DR Congo

Na so Zambia go boost dia chances wit a win afta dem draw 2-2 wit Morocco for di group A opener.

Zambia dey wear dia burnt orange jersey wey Senegal dey wear all-white.

Both teams don commot for di pitch

Dis na di lineups for both teams

Zambia: Ngambo Musole (GK); Lushomo Mweemba, Mary Wilombe, Grace Chanda, Barbara Banda, Martha Tembo, Ireen Lungu, Rachael Kundananji, Rachael Nachula, Mapalo Maluba, Prisca Chilufya

Senegal: Adji Ndiaye (GK); Aissatou Fall, Wolimata Ndiaye, Adama Sane, Mareme Babou, Meta Kande, Bineta Seck, Korka Fall (c), Mama Diop, Ndeye Casset, Nguernar Ndiaye

Welcome una to di live text commentary for dis ogbonge game for di Wafcon 2025.

Zambia go clash wit dia group A leaders Senegal for di second game for di ongoing Wafcon for Morocco.

Di team bin fight to get 2-2 draw for dia group opener wit host nation Morocco last week.

Senegal on di oda side bin win dia game 4-0 against DR Congo.

Zambia bin get two of di most expensive players for di world inside dia team; Racheal Kundanaji and Barbara Banda wey be di reigning CAF and BBC player of di year.

In fact, Barbara bin score di first goal of di competition under 2 minutes for dat game v Morocco.

For dia group, Senegal dey di top wit 3 points, Morocco na second wit 1 point, same as Zambia wey dey third.

DR Congo dey di bottom of di table.

Zambia team

Wia dis foto come from, FOOTBALL ASSOCIATION OF ZAMBIA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Zambia bin win di last game between dis teams 4-2 for penalties for di 2022 wafcon